Contact Form

Name

Email *

Message *

Tuesday, April 4, 2023

CAMPAIGN FOR EDEN! 📊



Wetin dey God's mind, wey make him create man...never understand me.
I no too Sabi wetin e dey think. God no fit be lonely now, but even with all the angels wey he get. Lucifer turn himself to hustler for heaven.
Him think say na election them go do last last. 
No be the thing wey they divide nation be that?
Election.
Him go campaign for some angel. God just dey look.
Pikin wey no Sabi wan carry throne.

Na Lucifer make Naira cost, no get value.
If he no carry election for head that time.
We for support who dey chair, no dey criticize person wey dey position.

Na since that time, man never satisfy. I no lie.

No be covetousness push Eve go chop forbidden fruit. That fruit no fit be apple. I think say God don pack the fruit for ground sef.

Fruit of knowledge. The fruit no dey now sef, person dey find power to chook eye for another person matter, see if him get glory pass him own.

Today, Election still dey go on o. Person dey choose say Lucifer Sabi sweet things, dey call Jesus fool. Another one go say nobody fit compare for him Jesus. Na this second table I dey.

The one wey shock me na the one wey talk say the two no do well, them no fit win. 

I dey wonder if Dem wan run for the election too, because if no be Jesus or Lucifer, na yourself you wan choose 

Abi may I tell am the truth? 
Okay, I go talk am.
Na the thing wey make you Lucifer brother be that. Him chose himself. Na the thing wey you dey do be that.

I don talk my own sote.
For Jesus campaign, we dey talk one thing. 
if you get ear to ear, make una hear wetin he don talk.

My guys, I go come back another time.

Use this small gist hold body.

#Aprokoweygojerusalem. #aprokonetwork.

No comments:

Post a Comment